Home » Police Arrest 100 Pipo During Alleged Gay-Marriage for Delta
Africa News Nigeria

Police Arrest 100 Pipo During Alleged Gay-Marriage for Delta

Police for Nigeria south-south state of Delta on Tuesday parade ova 100 pipo wey dem arrest for one event.Di police reveal say dem gbab di suspects during one gay-wedding ceremony inside one hotel for di state. Like most kontri for Africa, same sex relatioship dey illegal for Nigeria. Pesin fit go to jail for 14 years on top say dem be member of LGBT community. Di police say “on di 27th of August, 2023, at about 0100 hours, while patrol team wey dey attached to di Ekpa poice station, bin dey patrol for dia visibility duty for refinery road, dem catch one suspect, wey be man but dey dressed like woman.

“Wen dem gbab am, e tell police say e be actor wey bin come from Lagos to Delta state to act feem. But upon more interrogation for station, di suspect tok for statement say, im dey among gay society and dem get ceremony for one hotel.” According to di Police tok-tok pesin Bright Edafe, na on 28th of August by 2am dem land for di hotel and at first dem bin gbab 200 suspects, most of dem dress as women. Oga Edafe say, “wetin funny pass for di mata be say we see two suspects, one as bride and one as groom and video dey wia dem dey perform dia wedding ceremony.”

Police add say afta dem screen di suspects, dem end up wit 67 suspects wey dem come parade on Tuesday. E say “dis act dey evil and we no fit copy di Western world. We dey Nigeria, we must to follow our culture. We must follow di law. Na very clear case.” ”We don see cases wia some males don defile male minors, e dey as serious as dat. Na im make di CP say make we parade dis ones”. Dis no go be di first time police for Nigeria don gbab pipo on top say dem dey practice homosexuality. For 2018, Police bin arrest around 60 suspects say dem bin dey do orgy for one hotel inside Lagos but di men refuse di charge say dem no catch dem dey do anytin.

LGBTQ mata for Africa

Di mata of legal violence against di LGBTQ community don dey rise for different parts of Africa ova di years. For Uganda, one 20 year old man dey face death penalty if dem find am guilty of di new controversial anti-gay law wey dem introduce for May, call am aggravated homosexuality. Di man chop accuse say im nack one 41 year old man. But e no clear wetin im do wey put am offor di aggravated homosexuality section as dat one involve homosexual sex with pesin wey dey underaged or wia dem infect pesin with disease wey no get cure like HIV. For neighbouring Ghana, lawmakers dey propose 10-year jail term inside new bill which dey criminalize LGBTQ+ activism in de country.

Di main objective of di 36 paged document, Proper Human Rights and Ghanaian Family Values Bill 2021 draft bill wan deal plus what dem say be “propaganda, advocacy for LGBTQI+ den related activities. Reason for di new Bill be sake of recent LGBTQ+ advocacy den activism which dey increase for Ghana. Dis Bill, when passed into law go make am impossible to even support or campaign for LGBTQ+ rights online like social media platforms. Kontris like Somalia, South Sudan, Mauritania plus odas wey dey practice Sharia law dey give death penalty.

Oda kontris dey punish same-sex relationships wit life in prison like for Uganda, Zambia and Tanzania. For Kenya, Malawi and Gambia, pipo fit chop reach 14 years for being in dis kain relationship. But, five African kontris get laws wey dey slowly backtrack on di anti gay laws wey be common tin across di continent. Dem be Namibia, South Africa, Angola, Botswana and Mozambique wey in some way decriminalize di practice. Of all of dem, na only South Africa don legalise same sex marriage and dem pass am into law for 2006.

For May 2023, Namibia Supreme Court rule say di kontri go recognize any kaim marriage wey happun between dia citizens and foreigners. Angola bin decriminalize same sex relationships for February of 2021. Botswana High Court join for 2019 to decriminalize same sex relationships. Mozambique also stop to dey use dia antigay law wey colonial leaders bin sama di kontri for 2015

Source: BBC

Translate