Home » America Embassy Warn of High Threat on Major Hotels for Nigeria Big Cities
News Nigeria United States

America Embassy Warn of High Threat on Major Hotels for Nigeria Big Cities

United States embassy for Nigeria don issue security alert wey warn of high threat on major hotels for Nigeria larger cities.

Di embassy for inside one statement on dia website wey dem issue on Friday 3 November tok say “America goment dey aware of credible information on elevated threat to major hotels for Nigeria.”

Di statement add say Nigerian security services dey work hard to counter di threat.

Meanwhile, US goment don advise dia citizens to consider dis informate wen dem dey arrange for lodging or dey visit major hotels for Nigeria.

Dem provide dia citizens addresses and phone numbers dem fit reach anytime dem need help.

Di US goment also advice dia citizens to dey extra careful wen dem dey major hotels, dey alert to dia surroundings, keep low profile plus review dia kontri travel advisory for Nigeria.

Dis security alert dey come less dan two month afta di US list states wey dia citizens no fit visit for Nigeria.

For di advisory wey dem release on 20 September 2023, di US goment warn dia pipo wey wan travel come Nigeria to reconsider crime, terrorism, civil unrest, kidnapping and armed gangs.

Borno, Yobe, Kogi and northern Adamawa states sake of terrorism and kidnapping.

Bauchi, Gombe, Kaduna, Kano, Katsina, Sokoto and Zamfara states sake of kidnapping.

Abia, Anambra, Bayelsa, Delta, Enugu, Imo and Rivers states (apart from Port Harcourt) sake of crime, kidnapping plus armed gangs.

For October, America bin advise dia citizens all ova di world to dey careful wen dem dey travel go various locations around di world.

dem bin categorize Nigeria under di third tier of caution alerts.

Source: BBC

Translate